Happy curfew week

Copied
 An Ebira woman this afternoon declared jubilation sharing free malt drinks in Lugbe, Abuja in support of the 24-hrs curfew in Kogi Central Senatorial District.

NEIGHBOUR: Mama Oiza wetin happen, you win promo?

MAMA OIZA: My brother, e pass that ooooh!

NEIGHBOUR: Wetin happen, dem don promote you for office?

MAMA OIZA: You no go understand.

NEIGHBOUR: At least now wey you don give me malt, make you tell me wetin dey make you happy like this make I join you jollificate.

MAMA OIZA: Dem don declare 24-hr curfew for Okene. God bless my Governor. I go vote for am again!

NEIGHBOUR: Madam, na so you wicked reach? People wey dey Okene dey complain of the curfew, you dey Abuja dey throw party take support am. Madam I no drink ya malt.

MAMA OIZA: Abeg, drop ma malt jare. You no see say Baba Oiza no travel for weekend? Every weekend na so e go dey travel go Okene say na wedding e wan go attend like say na im be the chief Imam. Abeg, im journey don tire me. Make dem put the curfew for Friday to Sunday every week jor. Ma brother, God bless the Governor.

HAPPY CURFEW WEEK TO MY EBIRA PEOPLE. #VoiceOfEbira

Comments